Ghana new coach: Carlos Queiroz dey appointed as head coach for 2026 World Cup

3
Ghana appoint Carlos Queiroz as head coach for 2026 World Cup

13 April 2026

New Informate 6 hours wey don pass

Read am in 4 mins

Di Ghana football association (GFA) don appoint Portuguese coach Carlos Queiroz as head coach of di Blackstars for di 2026 World Cup campaign.

Dis dey happun weeks afta di association bin fire coach Otto Addo afta Ghana lose back-to-back friendly games to Austria and Germany.

According to tok-tok pesin for di GFA, "di executive council work wit all stakeholders to appoint Carlos Queiroz."

Carlos Queiroz go manage at least di kontris three group stage games against Panama, England and Croatia.

Di appointment dey happun under two months to di World Cup at a time when Ghana bin suffer injuries to key players.

According to statement by di GFA, "di 73-year-old go begin work immediately to prepare di Black Stars for di tournament wey go begin on 11 June."

Ghana go play dia first group L game against Panama on 17 June for Toronto bifor dem go face England and Croatia for di oda two games.

Di Black Stars bin comot di 2022 World Cup for Qatar wit one win (South Korea) and two defeats (Portugal and Uruguay).

Di team fail to qualify for di 2018 edition but for di 2014 tournament for Brazil, di team also comot for di group stage wit only one point (wit Germany) and two defeats (USA and Portugal).

Di kontri most successful tournament na for 2010 wen dem reach di quarterfinal bifor dem lose for penalties to Uruguay.

Overall, Ghana don qualify for four tournaments wit total of five wins, three draws and seven defeats.

Who be Carlos Queiroz?

Oga Queiroz bin dey coach for ova 37 years, wey im win di World youth championship wit Portugal team wey include Luis Figo, Rui Costa and Joao Pinto.

For 1991-94, Queiroz bin coach di senior Portugal team bifor im move to Sporting Lisbon.

For 1996, Queiroz coach New Jersey Metro Stars for di America Major League Soccer (MLS), bifor im travel go Japan to coach Grampus Eight.

Carlos Queiroz coach di United Arab Emirates (UAE) national team for 1999 wey im finally take ova for South Africa for 2000.

Two years later, di gaffer resign and get appointment as assistant manager for Manchester United for June 2002.

In all, Carlos Queiroz carry different teams go five World Cup tournaments wey dem play 16 games (4W, 4D, 8L), wit 19 goals scored and anoda 19 goals conceded.

Click here to read article

Related Articles